Tuesday 8 March 2016

DEAR JOHN


Dear John
Your gate man say you no dey house, but  I dey see ur motor inside compound. I know say e don reach two years wey we see and I know say you you fit still dey vex  for me.
Last wednesday, I see your pic for Facebook. Ma mind cum cut, becuz I know say wetin I do u, no good




Water dey full my eye wen I rememba how our luv been dey sweet. E dey pain me say I break your hart....e dey pain me say I return your engagement ring. Na devil work. I swear to God because i love you well well.

E dey like say na becuz of me wey  that yoruba girl when dem call Adele sing dat her music, "Hello". My luv, I dey sorry.  I still save all your sweet sweet  text message for ma fone, wey you dey take totori me for body those days.

I still dey FEEL u, and I hope say we fit come back. I dey sorry and remember say you talk say You no go ever forget me and our love. I don dey think of you tay tay, sotay to chop sef dey hard me.


Abi u don get anoda Boo? If na so, I no go blame u, (e go pain me sha) but I go understand. But I know say no woman fit love you the way me I love you. Remember how e been dey when our love strong kakaraka.

E be like say U don change your numba....I don call am taya. My own neva change. Make we try talk. I dey wait for your answer Johnny my love.

Na me, your one and only.
Jane.







Dear Jane,

I take God name beg u, no near my house again.


Wish kind harmattan breeze blow u cum ma house? Abeg no reach here again O. And how u take see ma pic  for FaceBook? Because, me I know say I don unfriend u tay-tay. So na wen u see pic of me inside my new motor u cum rememba me? And which time u start to listen Adele? Becuz me I no say na only Makossa u like. No be you been dey talk say Love song na wash? Say no be love person go chop?

Abeg flush!

Devil dey house with him wife dey sleep, him hand no dey dis one. Na your ong-throat cause am. Shebi you don forget say na me be the same Johnny the poor lover boy, the one wey you disgrace everywhere when you talk say you no do again, say you no go die for poverty. Abi now na the poverty you dey find.


Yes, I don get new Boo. D babe fine pass u, WELLA.  I think na u wey say I no get moni? I think na u wey call me poor man? U say I no be your level. U say na Rich maga u dey find. Biko go! I thank God say my levels don change. I go soon marry my new Boo. Carry your mumu numba go, becuz I know say the way e dey you now, common credit for fone you no get.


I no want again. I don pass your level. Me and you no be the same category. Abi you wan turn me to your maga? All those days when I been dey cry, dey beg you up and down, even your mama when I been dey help too, pour me dirty water for una house.

Now you wan come back to me. I chop winch? Abi na you chop crase?

If u near ma house again, na dog my gateman go release for u.

Person wey no want you again.
John

16 comments:

  1. Loooooool. Lovely but that John suffer for Jane hand o. Loooool.

    ReplyDelete
  2. Replies
    1. Jane park well. John don upgrade.
      It's difficult to persevere especially if you're unsure how the guy is gon treat you when he eventually hits the jackpot.
      Earn your own as a lady & don't let him pull you down with "loan".
      To each his own.
      All the best to everyone in love. May it be real & rewarding.

      Delete
    2. Stick with him, I know it ain't easy financially now but it's definitely going to get better. Lovely boys you've got by the way.

      Delete
  3. Johnny don hammer,Jane wan come back
    Mba ooo.....we no go gree.

    ReplyDelete
  4. Lolz Johnny don vex...Aunty Jane even your boo get a boo

    ReplyDelete
  5. Story of our artificial world. Jane, biko gawa!

    ReplyDelete
  6. Hahahahaha! The quest for material stuff is real.

    ReplyDelete

Comments are welcome......
Spammers on the other hand, would be shot, run over with my car, thrown off a cliff,
hung by their toe nails, and made to watch me do the MAKARINA....... in slow motion.
I'm just saying


would you like to advertise your goods and services on this blog? simply send a mail to opustjk@gmail.com



CONNECT WITH US
Join our bbm channel C004A948B
Facebook page www.facebook.com/opustjkwrites
twitter/instagram @opustjkwrites


For erotica, visit www.sexandcrazy.blogspot.com.ng

Sister Priye 2

"So...uh." I began. His good looks were over powering. "Mr...um..." "Black." He replied. "Richard Bla...